Sports

802 Results / Page 5 of 90

Background

Sports

Everywhere Choke As 2026 FIFA World Cup Round of 16 Dey Near

As e be like dis, na only 10 countries don already secure dia place for 2026 FIFA World Cup Round of 16, as di battle for di trophy dey hot. Di latest teams wey qualify na USA, England and Belgium as dem beat dia opponents yesterday. Di other teams wey don book dia tickets to di last 16 na France, Brazil, Norway, Morocco, Paraguay, Canada and Mexico. And later dis […]

todayJuly 2, 2026 13

Sports

Pape Gueye Retire From International Football

Senegal midfielder, Pape Gueye, don announce say e no go play for Senegal national team again as long as head coach, Pape Thiaw, still dey in charge. Di 27-year-old make di announcement for social media after Senegal blow two-goal lead come lose 3-2 to Belgium after extra time for dia 2026 FIFA World Cup Round of 16 match. For di post wey e write for French, Gueye tok say e […]

todayJuly 2, 2026 14

Sports

Belgium Shock Senegal with Late Comeback, Knock Senegal Comot 3-2

Nor be small drama, as Belgium complete one big comeback after beating Senegal 3-2 for extra time inside World Cup last-32 match wey happen for Seattle on Wednesday. Senegal bin dey lead 2-0 through Habib Diarra and Ismaila Sarr, but Romelu Lukaku and Youri Tielemans score late goals for di last four minutes to force extra time. For di 125th minute, VAR confirm penalty after Lamine Camara foul Tielemans, and […]

todayJuly 2, 2026 19 2

Sports

England check body say dem Nor Go Underrate DR Congo

Unto world cup update, England go face DR Congo on Wednesday for World Cup Round of 32 as dem dey fight to qualify for last 16. England coach Thomas Tuchel warn say make im players no underrate DR Congo, even though England na di favourites, inside dis competition big teams don see shege banza. England go depend on Jude Bellingham and Harry Kane to deliver, but defender Reece James no […]

todayJuly 1, 2026 8

Sports

Mbappe And Olise Shine As France Brush Sweden

By: Yusuf Abuh France pull weight for World Cup as dem beat Sweden 3-0 on Tuesday to enter tdi round of 16 match where dem go face Paraguay. Kylian Mbappe score two goals inside di heavy match inside MetLife Stadium for New Jersey, and di first goal enter small time before half-time after France hit post two times. Michael Olise ball wetin nor good, for di match as na im […]

todayJuly 1, 2026 27 1

Sports

Esther Okoronkwo Bounce Back From Wunjury

Small moral don enter Super Falcons camp as  midfielder Esther Okoronkwo return to action for AFC Toronto, playing 25 minutes as dem beat Vancouver Rise 3-1 on Sunday. Di 29-year-old bin stay out for almost two months because of wunjury  wey she suffer during one league match against Halifax. Her comeback don give Nigeria better hope as di Super Falcons dey prepare for 2026 Women's Africa Cup of Nations wey […]

todayJune 30, 2026 12

Sports

How Germany Disgrace Dia Village Pipo For World Cup

Germany don do surprise crash out of di World Cup afta Paraguay beat dem 4-3 for penalty shootout, say both teams play 1-1 for regulation and extra time on Monday. Julio Enciso naim score first for Paraguay before Kai Havertz equalise for Germany with im third goal of di tournament. VAR con cancel Jonathan Tah extra-time goal, as Paraguay hold strong reach penalty shootout. Goalkeeper Orlando Gill save two German […]

todayJune 30, 2026 8

Sports

Late Goal Carry Canada Enter World Cup Round 16

Canada don qualify for World Cup last 16 for di first time after Stephen Eustaquio score late winner wey give dem 1-0 victory against South Africa on Sunday for di first knockout match. Di game bin dey wan enter extra time oh, before Eustaquio fire one fine shot from outside di box for stoppage time to break South Africa heart. Canada, wey dey co-host di tournament, go now face either […]

todayJune 29, 2026 8

Sports

From Naija To NBA: Six Players With Nigerian Roots Make Draft

Six players wey get Nigerian roots don enter di 2026 NBA Draft, including Felix Okpara, Otega Oweh, Tobi Lawal and Ugonna Onyenso. Orlando Magic pick Okpara as number 46, while Houston Rockets choose Onyenso as number 53 for di draft. Onyenso start as football player for Nigeria before e switch go basketball after e move go America in 2018 and train for NBA Academy Africa for Senegal. Di Imo-born player […]

todayJune 26, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds