Sports

977 Results / Page 7 of 109

Background

Sports

Lionel Messi Wan Buy Majority Share For Spanish Club

By: Mariam Ajayi Football star Lionel Messi dey set to become majority owner of Spanish second division club, Eldense. Di deal still dey wait for legal processes, due diligence and approval from Spain National Sports Council before e fit complete. If everything go through, Eldense go become di second Spanish club wey Messi invest inside, after e acquire fifth-tier Catalan club Cornella for April. Messi recently retire from Argentina international […]

todaySeptember 9, 2026 9

Sports

Zidane Tell Messi Doubters Say Dem No Understand Football

By: Kofoworola Olayinka French football legend Zinedine Zidane don throw him weight behind Lionel Messi for di GOAT debate, saying anybody wey still dey doubt Messi greatness no really understand football. Zidane talk say Messi still dey among di best footballers for di world at 39 years, and e no go surprise am if di Inter Miami star win di 2026 Ballon d’Or. Messi, wey don win Ballon d’Or eight […]

todaySeptember 9, 2026 17

Sports

Courtois Say E No Go Play for Belgium Till 2027

By: Kofoworola Olayinka Real Madrid goalkeeper Thibaut Courtois don decide to pause im Belgium career till September 2027, so e no go play for di coming Nations League campaign. Courtois make di announcement on Wednesday after new Belgium coach Mark Van Bommel tell am say e no fit guarantee am di first-choice goalkeeper position. Di 34-year-old, wey don play 115 times for Belgium, say e go make im return for […]

todaySeptember 9, 2026 14

Sports

Lamine Yamal React As Dembele Snub Am

Barcelona winger Lamine Yamal don react after Ousmane Dembélé no include am among im top three players for Ballon d’Or. Yamal jokingly ask whether Dembélé friendship with Kylian Mbappé fit get anything to do with di decision. Yamal make di comment after football transfer expert Fabrizio Romano post am for X on Wednesday. With smile, Yamal talk say, “Na Kylian Mbappé padi e be, abi?” But Yamal say e no […]

todaySeptember 9, 2026 16

Sports

NFF Appoint Eguavoen and Danjuma To Coach Di Falcons

By: Adekunle Damilola Nor be small shocky shocky for Naija football space, like dis na NFF give senior man, former Super Eagles coach, Augustine Eguavoen AKA Cerezo, say make im go role with di babes as interim coach of di  Super Falcons so dat dem go focus on  dia 2028 Olympic Games qualifiers. Say na Cerezo go train di senior girls as dem dey prepare to face Comoros for di […]

todaySeptember 9, 2026 14

Sports

No Naija Player, Coach Make Ballon d’Or Nominee List

By: Ayobami Dada No Naija player, coach or team make the Ballon d’Or nominee list wey dem release on Tuesday. Last year, Super Falcons goalkeeper Chiamaka Nnadozie make the Women’s Yachine Trophy shortlist, while Falcons coach Justine Madugu also enter nomination for Women’s Team Coach of the Year. Dis one come after Falcons win their record-extending 10th WAFCON title for Morocco, but Naija senior men and women teams no qualify […]

todaySeptember 8, 2026 16

Sports

Falconets Chop 2-0 First Breakfast For World Cup

By: Yusuf Abuh Falconets don chop first breakfast for FIFA U-20 Women’s World Cup as defending champions Spain show dem pepper 2-0 inside Poland on Monday. Di Spanish girls hold ball like say dem own am, come open score line for 13th minute through Marisa Garcia to put Nigeria for tight corner for ArcelorMittal Park. Coach Moses Aduku girls try dia best to equalize di score, but Spain solid defense […]

todaySeptember 8, 2026 16

Sports

Okonkwo Get Naija Call-Up for AFCON Qualifiers

By: Ayobami Dada Arthur Okonkwo don receive Naija call-up for di AFCON qualifiers against Madagascar and Guinea-Bissau. Di 24-year-old goalkeeper wey dey on loan at Charlton from Wrexham go compete with Stanley Nwabali and Maduka Okoye for starting spot. Naija go host Madagascar for Uyo on September 25 before dem travel go face Guinea-Bissau four days later.

todaySeptember 7, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds