Sports

671 Results / Page 6 of 75

Background

Sports

Barcelona Eye Victor Osimhen As Atlético Hold Julián Álvarez Tight

By: Esther Ayoola Barcelona don start dey look Victor Osimhen as pa say Atlético wan stress dem for Julián Álvarez deal. According to transfer experts, dem bin first want Álvarez for dis summer transfer window, but Atlético dey hold dia player kakaraka. Now, Barcelona dey reason both Álvarez and Osimhen as possible way dem fit replace veteran forward Robert Lewandowski. Álvarez dey cost around €200m, wey fit make am one […]

todayApril 7, 2026 3

Sports

Mbappe Set To Shine As Madrid Face Bayern For UCL Clash

Real Madrid coachie Arbeloa don konfamate say, star boy, Kylian Mbappe go dey available for di Champions League clash with Bayern Munich on Tuesday. For Pre match conference, Di Coachie explain say Mbappe na very important player for di team. Mbappe wey be their top scorer nor start di last games against Manchester City because of knee injury, but di team still win wella. Now wey e don recover, coach […]

todayApril 6, 2026 2

Sports

Inter Milan Extend Dia Lead For Seria A Beating Roma 5-2

Inter Milan  knack Roma 5-2 for Serie A inside San Siro on Sunday, to take dia lead to nine points ahead of AC Milan. Lautaro Martinez come back from injury, score two goals, while Marcus Thuram score im first goal since February. Hakan Calhanoglu score beta shot before half-time and Nicolo Barella add another one, making it a sure win.

todayApril 6, 2026 8

Sports

Chukwuma Beat Ofili, Win First Outdoor Doings For Louisiana

Nigerian sprinter Rosemary Chukwuma don start her outdoor season with beta result, wining di Battle for Bayou matas wey hapun for Louisiana. She run 10.81 seconds (+3.1 m/s) to beat her training partner Favour Ofili and Canada’s Audrey Leduc, wey finish together for 10.93 seconds. Chukwuma pick race for di blocks, sharp-sharp and hold her lead till di finish, even as Ofili try rush at di end. Dis timing sef […]

todayApril 6, 2026 3

Sports

Remo Stars Nail 3SC, Kano Pillars Hammer Bendel Insurance 4-0

Interesting games na sup for di Nigeria Premier Football League, match day 33, say Remo Stars record 1-0 win over Shooting Stars for Ikenne on Sunday as Samuel Anakwe score di only goal after half-time. For other matches, Kano Pillars hammer Bendel Insurance 4-0, while Kwara United waka pass El-Kanemi Warriors 3-0. Rivers United lose 2-0 to Warri Wolves as Nasarawa United collect 0-1 lose to Kun Khalifat.

todayApril 6, 2026 5

Sports

Chelsea Suspend Enzo Fernandez Say Im Break Club Rules

Say like dis na, Enzo Fernandez no go play for Chelsea for di next two matches after im talk about im future. Dis na according to update by coachie Liam Rosenior for im pre match conference. According to Rosenoir, di club get ruled and Enzo don pass di line as make comment say im wan join Real Madrid. Di 25-year-old Argentine wey join Chelsea January 2023 for record £107 million, […]

todayApril 3, 2026 19

Sports

Italy To Lose Euro 2032 Hosting based On bad Stadiums

Say like dis Italy fit lose their chance to co-hosting right of Euro 2032 if dem no fix their stadiums fast. According to UEFA president Aleksander Čeferin, Di country suppose host di tournament with Turkey, but bad infrastructure don put dem for serious doubt. Italy football federation get till October to present five stadiums wey go meet UEFA standard or dem fit lose di hosting rights.

todayApril 3, 2026 12

Sports

Former Arsenal Star, Gallas Name Di Cup Wey Arsenal Fit Win

Former Chelsea and Arsenal defender William Gallas tuk say di only trophy wey Arsenal fit win dis season na di Premier League. Dem bin dey try for quadruple, but dem lose Carabao Cup final to Manchester City. Now, Mikel Arteta side, dey fight for Premier League, FA Cup and Champions League. Gallas say e no believe say Arsenal fit win all three trophies dis season.

todayApril 3, 2026 5

Sports

Super Eagles To Face Poland, Portugal For Big June Friendlies

Say Nigeria go play Portugal and Poland for big international friendly games for June. Super Eagles, wey just beat Iran 2-1 and draw 2-2 with Jordan for Antalya, Turkey, don dey ready for dis summer programme against European teams. Dem go face Poland for PGE Narodowy Stadium, Warsaw on June 3, before waka go Portugal for second friendly on June 10. Portugal don also konfam say Nigeria go be dia […]

todayApril 3, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app