OBODO NAIJA

Comot If You No Go Support APC – Samuel Danjuma Shekwolo Yarn

todayAugust 25, 2026 4

Background
share close

As 2027 general election dey come near, Kuje Area Council chairman for FCT, Samuel Danjuma Shekwolo, don threaten say e go resist residents wey wan vote against di ruling All Progressives Congress (APC).

For one video wey dey circulate for social media, Shekwolo say e no go allow anybody for di council work against APC or oppose Presido Bola Tinubu second-term ambition.

Di chairman point to development projects wey Presido Tinubu and FCT Minister, Nyesom Wike, don carry out for di area council, say na why residents suppose support di ruling party.

E vow say e go use im office fight against anybody wey oppose APC during di 2027 election.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds