OBODO NAIJA

Defence Minister Say Soldiers Salary Increase Dey Come Soon

todayJuly 28, 2026 3

Background
share close

By: Esther Daniel

Defence Minister General Christopher Musa don say President Bola Tinubu go soon announce salary increase for Nigerian Armed Forces personnel to improve dia welfare.

Musa talk dis through him media aide, saying di move na part of government plan to reward soldiers for dia sacrifice and service to di nation.

Di minister remind Nigerians say military pay don rise from N49,000 to N100,000 during him time as Chief of Defence Staff.

Musa say gornment dey work on better welfare package for troops as dem continue efforts to increase dia salary again.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds