OBODO NAIJA

El-Rufai Don Return Court For Corruption Trial

todayOctober 13, 2026 6

Background
share close

By: Jolayemi Olajide 

Former Kaduna State Gofnor, Nasir El-Rufai, don reach Kaduna State High Court on Tuesday as im corruption trial continue.

ADC gornorship candidate, Isa Ashiru, follow am go court, after Justice Darius Khobo order ICPC to bring El-Rufai come court for di trial.

El-Rufai dey ICPC custody since February 18, 2026, over allegation of financial wahala wey concern how e run Kaduna State from 2015 to 2023.

Di former governor dey face different cases for different courts, but e don deny all di allegations and plead not guilty to di charges.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds