By: Yusuf Abuh
Nor be small tin Russia dey do oh, dem blast Ukraine again, kpaing at least 18 pipo for Kyiv, Ukraine, for di second time within one week.
Dis attack sef hapun, just before di important NATO meeting, and like dis, Ukraine presido Volodymyr Zelensky dey beg frens and family to con help defend Ukraine.
To tell u how di mata serious reach, European Union sef don konfam say, true, true, Ukraine need more air defence support, say di Russia strike destroy part of one storey building and cause e serious damage for Ukraine.