By: Esther Ayoola
Tyson Fury manager, Spencer Brown, say, like dis, dem sti dey find warm up match for Fury before im go face Anthony Joshua for di big showdown wey everybody dey wait.
Fury just come back to ring earlier dis month, and e beat Arslanbek Makhmudov for Tottenham Hotspur Stadium afta 16 months break.
Afta di fight, Fury con push for Joshua fight, say, im don sign im own part of di deal already.
But Joshua side never decide, as e sti dey consider two-fight offer from Saudi boxing chief, Turki Alalshikh.