OBODO NAIJA

How Gunmen Kpai 29 Pipo for Adamawa Community

todayApril 28, 2026 5

Background
share close

Say nor be small badness yesterday, as Gunmen attack Guyaku and Telabala communities for Gombi LGA of Adamawa State, kpaing nothingĀ  less than 29 pipo.

Witness tuk say di attackers enter during one football match for primary school around 5pm Sunday, begin shoot anyhow, pipo begin run for safety.

Di gunmen no stop for there, dem still burn some religious buildings, while residents cry for di loss of dia family members.

Untop inspection waka, Governor Umaru Fintiri visit di area and call di attack very painful, instructing security to begin investigation.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds