Lagos

Lagos Assembly Agree New Bill Wey Go  Hellep  Future Generations 

todayJune 4, 2026 4

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Lagos Assembly don gree on the new Lagos State Wealth Fund Bill, 2025 to keep money for future generations.

Di oga  kpatakpata of Finance Committee, Hon. Obafemi Saheed,  dey ground for di house of assembly read di report to the House after di bill pass second reading.

From dere,  senior man Speaker,  Mudashiru Obasa con konfam dis ogbonge bill wey go make Lagos rich, say na only people wey get sense and heavy experience go manage dis wealth fund.

As the elders dey talk, “tree wey strong today, na because dem look am well when e dey small,” so like dis di lagos state House of assembly  don  secure di state future with dis ogbonge bill.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds