Lagos

Lagos CP Tell Residents to Blow Whistle for any Corner-Corner Movement

todayJune 4, 2026 2

Background
share close

By: Jolayemi Olajide

Lagos  Oga Commisioner of Police,  Tijani Fatai,  strong face today,  condemn di school kidnapping katakata for Oyo State.

Oga Fatai  yarn dis one on Thursday, when konfam 89.5FM newsroom waka go pay am courtesy visit for im office.

As questions take reach im side  concerning di security mata for Lagos, di CP yarn say, for now, Lagos dey calm and peaceful but di police still need beta help say,  na corporation dey make rice full pot.

Oga fatai  con sti press tuk say pipo of lagos need  shine dia  eyes, once any strange movement hapun,  sharpaly put call across to di police,  say mehn mount every conner.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds