A new Mother, of African decent, proudly holds her newborn baby out in her arms as she sits up in her hospital bed. She is wearing a hospital gown and is gazing down at her baby boy as she studies his features.
Lagos State Gornment don start new arrangement to reduce deaths wey fit dey avoided among pregnant mama and new born pikin dem.
Di plan go focus on how dem go train health care workers and make sure say hospitals dey kampe to collect any kine emergency and helep patients on time.
Di plan come out for di three-day meeting wey Lagos State Ministry of Health organise with TEAM OB/NEO for Alausa, Ikeja, di meeting start from November 10 to 12, 2026.
Special Adviser to di Govo for bodi mata, Dr Kemi Ogunyemi, tok say make mama dey bleed after she born, serious high blood pressure for pregnancy and wahala wey affect pikin wey born before time still dey cause deaths.
She press mouth say health workers must sabi how to notice danger signs quick, talk to each oda well and give correct help on time.