By: Yusuf Abuh
Lagos State Gornment don tell people wey dey stay for Lekki, Ikorodu, Ajegunle and Isheri OPIC make dem quickly comot go higher ground as heavy rain fit cause anoda serious flood.
Environment Commissioner Tokunbo Wahab yarn dis one for TV on Tuesday, say anybody wey dey flood-prone area no suppose wait until water carry property or put life for danger.
Di warning follow heavy rainfall wey start Sunday night and continue reach Monday, wey flood plenty parts of Lagos.
Wahab still reassure residents say places like Epe, Mushin and Ikeja dey relatively safe despite di heavy rain.