American boxing champion, Floyd Mayweather Jr., don pay visit to di Govo of Lagos State, Babajide Sanwo-Olu, for Lagos House, Marina, on Sunday November 15th 2026.
Di before-before five-division world champion come Nigeria to start one ogbonge boxing programme wey dem call TMT Frontrow Fight Series.
Dis programme wan find, train and promote young Nigerian boxers by boxing school wey dem plan to open for Lagos and other cities.
Di first show for dis boxing series go happun for 2027, and dem expect say Floyd Mayweather Jr. sef go enter ring fight for Nigeria that same year.
Govo Babajide Sanwo-Olu troway salute give di boxing legend and konfamate say Lagos State gornment ready to join body work with am on top di project.