By: Yusuf Abuh
Lagos State Gornment like dis now, don announce plan wey dem go take make waste management beta for di obodo Lagos, say dem wan change di old dumpsites and replace dem with material recovery centres and waste-to-energy plants.
Lagos waste manement oga, Muyiwa Gbadegesin fire dis mata on Tuesday during di agency mid-year media tuk tuk for Ijora-Olopa, Lagos.
Im say di new plan go focus on beta waste infrastructure, new ideas, stronger enforcement and moving Lagos towards a system where waste fit become useful materials again.