By: Esther Ayoola
Lagos State Traffic Management Authority tuk say na about 69 pipo don kpai like dis for road askident across Lagos between January and March 2026, while 246 others get wunjuries.
LASTMA General Manager, Olalekan Bakare-Oki naim yarn dis one for interview with News tatafo on Sunday.
Say drivers just dey drive wawa and naim dey cause all these askidents.
E sti tuk say dem clear over 600 accident scenes and handle more than 900 truck-related offences, plus 4,900 physical enforcement operations to control di situation.
According to am, dem also record 17,942 traffic violations through technology, and say LASTMA go continue strict enforcement and carry offenders go mobile court to reduce road accidents.