OBODO NAIJA

Makinde Ask “Nigerian Economy Dey Grow, But Nigerians Dey Feel Am?”

todayAugust 10, 2026 3

Background
share close

By: Esther Daniel

Oyo State Gofnor Seyi Makinde don ask whether Nigerians dey feel di impact of Nigeria’s growing , for im August 2026 newsletter, “Di Business of Governance,” because economic growth suppose improve people lives.

Makinde tok say Oyo State and National Bureau of Statistics don release fresh economic figures, wey show say GDP(Gross domestic product ) dey grow, gornment revenue dey rise and budgets dey get implementation.

Di gofnor say e believe economic growth no suppose just dey for paper, but im must create more opportunities for Nigerians to earn better money, while businesses go grow and employ more people.

Makinde explain say na why Oyo State gornment dey use “from poverty to prosperity” as one of dia key messages, as im call for economic progress wey ordinary Nigerians fit see and feel

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds