By : Jolayemi Olajide
Senator Natasha Akpoti-Uduaghan wey dey represent Kogi Central Senatorial District don officially submit her PDP senatorial nomination form for di party national secretariat, Wadata Plaza for Abuja, dey prepare for di 2027 general elections.
After submitting di form, Natasha do one or two tori pipo, say her decision to seek re-election no be just for personal ambition, but to continue purposeful representation for Kogi Central.
She also tuk say she wan continue to empower youths and women, and make sure say di dividends of democracy reach every part of di senatorial district.
Natasha thank di pipo of Kogi Central and PDP members for dia continued trust, support, and confidence in her leadership.