By: Kofoworola Olayinka
NDLEA don bust one international cocaine cartel wey allegedly dey use Nigeria as road to move illegal drugs go UK, Europe and Asia.
According to report say dem arrest di alleged Nigerian leader of di group, social media influencer Afolabi Kazeem Michael, aka KC Luxury.
NDLEA Chairman, Brigadier General Mohamed Buba Marwa, yarn dis one for Lagos on Tuesday,
Di agency say e arrest am as e dey try comot Nigeria, while dem seize 184.50 kilogramme of cocaine from di operation.
Di agency say di cocaine seizure na di biggest wey any courier company for Nigeria don record.