By: Kofoworola Olayinka
NELFUND Boss, Akintunde Sawyerr, don deny down allegation say money dey miss for di agency, e tok say nobody get evidence to prove say dem mismanage money.
Sawyerr yarn dis one for TV siddon tok on Monday, saying NELFUND need money to give students loans and say di scheme na part of Federal Gornment plan to redirect money enter welfare programmes.
E say make people understand say before students fit collect loan, gornment must first get money wey dem go use fund am.
Sawyerr also link di scheme to Presido Bola Tinubu decision to remove subsidy and redirect di money wey suppose go to top people into welfare programmes, including NELFUND.