OBODO NAIJA

Obi Call Tinubu Say Make E Resign Over Hardship

todayJune 23, 2026 1

Background
share close

By: Yusuf Abuh

 

Presidential candidate of Nigeria Democratic Congress, Peter Obi, don call out wi oga Presido Bola Tinubu, say make e resign, saying di gornment don fail Nigerians as hardship, insecurity and poor living condition use rain coat wear Nigerians.

Obi tuk dis one for im X handle on Monday after British Prime Minister Keir Starmer announce say e go step down from office.

Di former Anambra govo say Starmer show how leaders suppose behave, when pipo nor happy with dia performance, just resign.

Obi also remind Nigerians say before Tinubu do same tin to former Presido Goodluck Jonathan cause of insecurity and economic wahala for di country.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds