By: Esther Ayoola
Oga Seneta wey dey represent Edo North for Senate, Adams Oshiomhole don call on Senate Presido, Godswill Akpabio, say make e resign over di new amendment for Senate Standing Orders.
Oshiomhole tok dis one for Abuja afta Thursday Plenary, say di new rules get “moral crisis”, dat person must do 8 years for senate before e go fit become senate presido, nor make brain and dat Even Akpabio nor follow di law.
Oshiobaba scatta mouth say, under di new arrangement wey Senate dey discuss, Akpabio nor suppose continue to lead di chamber because e no meet di moral and procedural standard an dat make Akpabio lead by example.