By: Esther Daniel
NDC presidential candidate Peter Obi don raise alarm over hunger and insecurity for Nigeria, say oga Presido Bola Tinubu-led APC gornment never do enough to fix di serious problems wey dey face Nigerians.
Obi drop di heavy words during funeral service for late Okaji Simon Okorie Abaa for Isiama, Ebonyi State, where crowd gather as he charge Nigerians to stand strong and defend dia votes for 2027.
Di former Anambra governor yarn say hunger no dey look anybody face, as economic hardship don dey bite families across villages and cities, mak life hard for many people.
Obi tell Nigerians say dem must make dia votes count, because na through strong people power and good leadership country fit escape di wahala of hardship and insecurity.