Oga Presido Bola Tinubu don approve make dem set up Presidential Task Force to prepare Nigeria against Ebola virus and other health issues.
Di Presido also order, make dem release ₦10 billion emergency fund sharply to help build wall of Jericho against di disease.
Dis na According to im tuk tuk person, Bayo Onanuga, say di money go hellep di NCDC, how dem dey respond to sickness.
Dis task force, wey Chief of Staff, Femi Gbajabiamila go lead, come out after big gornment pipo meet on how to stop Ebola make e no enter Nigeria.