By: Mariam Ajayi
Presido Bola Tinubu don order total reconstruction of di Benin-Agbor-Asaba road and other major federal highways for Edo State and nearby areas.
Minister of Works, David Umahi, give di order on Tuesday when e inspect di bad Benin-Agbor-Asaba road and apologise to motorists over di hardship wey dem dey face.
Umahi also condemn di contractor wey dey handle di road after hin accuse rain say naim dey spoil di road.