south west

Senate explain to Makinde why im need to dey careful with security mata

todayJuly 14, 2026 8

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Senate don warn Oyo State Govo, Seyi Makinde, say make e no dey make statement wey fit spoil Federal Gornment and security agencies effort to fight terrorism and kidnapping, after e call on United Nations make dem investigate the abduction of school children and teachers for Oriire Local Government Area.

Senate give di warning after dem discuss motion wey Senate Leader Opeyemi Bamidele bring about di successful rescue of the 39 pupils and seven teachers, plus the sacrifice wey security officers make during the operation.

Lawmakers still praise President Bola Tinubu and security agencies for the order and work wey lead to the victims’ release after more than 50 days in captivity.

Dem also tuk say di operation end with di arrest of eight suspected terrorists while security forces neutralise several others.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds