For Abuja, Senate Committee on Public don order security agencies make dem arrest former NNPCL Group Chief Executive Officer, Mele Kyari, after e fail appear before di committee hearing.
Committee Chairmo, Senator Ibrahim Dankwambo naim lead di session wey dey touch light di allegation about ₦210 trillion wey miss road between 2017 and 2023.
Some lawmakers say, make dem give Kyari anoda chance because reports say e dey Germany for medical treatment.
Di committee later approve arrest warrant after Senator Victor Umeh move di motion, saying Kyari failure to honour di invitation spoil work for dem.