OBODO NAIJA

Shettima Order NEMA To Prepare For Flood

todayJune 26, 2026 6

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Vice-Presido, Kashim Shettima don direct National Emergency Management Agency, NEMA, and other gornment agencies make dem start work for  flooding now, make e nor con spoil something later.

Di senior man vice presido give dis order on Thursday during meeting with di emergency task force pipo for Aso Villa, Abuja.

Dis one follow National Economic Council approval of N83.2 billion on June 18 to support plans wey go reduce flood impact.

Shettima say, agencies gat make every tin clear oh to protect lives and property before rain go start fall spoil tins for Nigeria

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds