By : Jolayemi Olajide
Super Eagles don open camp for Warsaw, Poland, as dem dey block body to face Poland and Portugal for international friendly matches.
Di players land Poland early Monday morning, on top di ginger of dia win for di 2026 Unity Cup wey dem play for London.
Team Media tuk, tuk, Promise Efoghe, naim sorosoke dis update, say 18 players don already show face for camp as at di time wey konfam package dis report.
Efoghe still talk say 16 out of the 18 players follow join body for di team first training session wey dem do on Monday evening.