Lagos

Suspected Cultists Kpai One Man For Ikorodu

todaySeptember 23, 2026

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Suspected cultists allegedly , don go kpai persin, wey name na  Tosin.  after dem rob am for Egbin area of Ijede, Ikorodu, on Tuesday, September 15.

Tosin reportedly, just  travel from Ondo State come attend one event for the community, as im just comot di party go one side na dis badness hapun.

According to  source say some Jagudas  allegedly attack am, collect im gold chains, mobile phones and other belongings, before dem con kpai  am.

As at di time wi package dis report, Police never fry mouth.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds