Bola Tinubu

93 Results / Page 4 of 11

Background

OBODO NAIJA

Primate Ayodele Don Predict Say Tinubu Fit Move Nigeria Capital Go Lagos If E Win for 2027

By: Mariam Ajayi Primate Elijah Ayodele, Popular cleric don predict say Oga Presido Bola Tinubu fit move capital of Naija from Abuja go Lagos if e win di 2027 presidential election.   Di cleric make di prediction for one video for X as Tinubu dey prepare to get anoda term for office.   Ayodele say if Tinubu win again, Lagos architecture go change and di capital fit move to Epe, […]

todayAugust 21, 2026 12

OBODO NAIJA

Tinubu Order Recovered EFCC Money Make E Go NELFUND

Presido, Bola Tinubu on Wednesday order say all liquid funds wey EFCC recover, plus unclaimed dividends, make dem divert go NELFUND to strengthen di student loan scheme. Minister for education, Tunji Alausa naim disclose dis after Federal Executive Council meeting for Presidential Villa, Abuja, on Wednesday. Alausa say Tinubu give di order to make sure NELFUND get enough money to continue funding students for long term. Di council meeting na […]

todayAugust 20, 2026 10

Politics

APM Rake Say Osun Election na sign Tinubu Nor get level for 2027

By: Kofoworola Olayinka Allied People Movement, APM, say di outcome of di Osun gofnorship election show say President Bola Tinubu no get easy road ahead for di 2027 presidential election. APM National Publicity Secretary, Yusuf Abubakar, say Nigerians no go support any political party wey fail to perform, whether di party strong or not. Di party say APC leadership and its national support for Bola Oyebamiji during di Osun election […]

todayAugust 17, 2026 22

Local

FG To Put 3,700 New Network Towers For Rural Areas

By: Kofoworola Olayinka Federal Gornment don start plan to build 3,700 telecom tower for villages across Nigeria. Communication Minister Bosun Tijani yarn this on Sunday for Ogboghoro Community, Delta State. He say di project go help bring better network to hard-to-reach riverine areas and connect more Nigerian to internet. Tijani say President Bola Tinubu approve di plan as part of gornment effort to build a $1 trillion economy.

todayAugust 17, 2026 15

Business

NUPENG Beg Tinubu To Stop Temporary Work For Oil Industry

By: Kofoworola Olayinka NUPENG President Salimon Oladiti don beg President Bola Tinubu to stop temporary work arrangements for oil workers. Oladiti make di request when NUPENG leaders visit Tinubu for Presidential Villa, Abuja. Tinubu say subsidy removal don help government pay salaries and fund major road projects across di country. He thank NUPENG for supporting government, saying di union play important role for Nigeria economy.

todayAugust 14, 2026 16

Politics

Osun Election: 1.9m Voters Ready To Decide Gorfnor

By: Kofoworola Olayinka About 1.9 million voters go decide Osun gorfnorship election tomorrow, with 15 candidate contesting di poll. President Bola Tinubu don assure resident of security and beg dem to come out vote. Fear rise after suspected political thugs allegedly shoot two APC members for Esa-Oke, as 15,000 policemen and other security workers dey send Gorfnor Ademola Adeleke, APC candidate Bola Oyebamiji and ADC candidate Najeem Salaam dey among […]

todayAugust 14, 2026 18

OBODO NAIJA

Nigerian Army Wan Add Four New Divisions To Fight Insecurity

By: Olabisi Olatunji Presido Bola Tinubu don agree to four new Army divisions wey go make security work stronger across Nigeria. Di new divisions go dey Benue, Kwara, Taraba and Edo States wey go make soldiers answer quick to security threats. Di Army don start work to make different groups wey dey work and make command reach everywhere well across di country. Gornment also plan to add 28,000 new soldiers […]

todayAugust 13, 2026 13

OBODO NAIJA

Army Colonel Wan Comot Our Presido Tinubu

Nigerian Army Colonel Mohammed Ma’aji, wey dem accuse say naim plan dat wicked move to  comot wi oga Presido Bola Tinubu from seat,  don rake, wetin give am mind, noobodi sabi, but im say na  patriotism and frustration, say wey hunger wire am ehn, nor be clear eyes im take plan corp. Ma’aji yarn dis wan for one  fresh court papers, di seniorman explain say hunger, hardship naim make im […]

todayAugust 11, 2026 18

OBODO NAIJA

Wike Deny Lobby For APC Campaign DG Job

By: Yusuf Abuh FCT Minister Nyesom Wike don on Monday deny report say e dey lobby to become Director-General of APC Presidential Campaign Council for di 2027 election. Wike fire dis mata through im Senior Special Assistant on Public Communications and Social Media, Lere Olayinka, talk say di report na false and e never discuss campaign council leadership or membership with anybody. E say e still dey support oga presido […]

todayAugust 11, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds