Bola Tinubu

93 Results / Page 6 of 11

Background

OBODO NAIJA

Former President Goodluck Jonathan Enter Aso Rock Meet President Bola Tinubu Behind Closed Doors

By: Esther Daniel Former Presido Goodluck Jonathan hold secret closed-door talks with Presido Bola Tinubu inside Aso Rock Villa for Abuja on Sunday to discuss silent plans about di 2027 presidential election. One media report di private meeting inside di Presidential Villa on Sunday through dia political correspondents to explain why no official statement come out after di discussions. Tanimu Turaki PDP faction submit Jonathan credentials through formal documentation give […]

todayAugust 3, 2026 16

OBODO NAIJA

SDP Presidential Candidate Adebayo Tell Tinubu To Park Im Kaya From Aso Rock

By: Yusuf Abuh Social Democratic Party presidential candidate, Adewole Adebayo, don tok say wi oga Presido, Bola Tinubu don already defeat himself ahead of the 2027 general election. Im yarn dis one TV sit down tuk say di gornment never solve poverty, insecurity and other governance problems, and say na why many Nigerians dey disappointed. E come advise Nigerians make dem face issues wey concern di country instead of putting […]

todayAugust 3, 2026 14

obodo oyinbo

US Don Vex! Blow Hot for Kaduna Massacre, Tell Tinubu “E Don Do!”

By : Jolayemi Olajide Di United States don strongly condemn di early morning attack wey happen on July 27 for one village in Kaduna State, where reports say at least 30 people, including children, lose dia lives after gunmen attack di community. For statement wey di US Bureau of African Affairs post on X, Washington tok say e dey deeply sorry for di families of di victims and condemn di […]

todayAugust 1, 2026 14

president Bola Tinubu

Politics

Tinubu Dash Jang Pikin Big Aso Rock Position, Surprise Crowd for Jos

By: Jolayemi Olajide Presido Bola Tinubu don appoint Yakubu Jang, pikin of former Plateau Gofnor Jonah Jang, as Senior Special Assistant for Office of di Presido, and Vice Presido Kashim Shettima announce am on Saturday during Chief Jang 80th birthday celebration and book launch for Jos, Plateau State. Shettima tok say na on behalf of Presido Tinubu e make di announcement, as di appointment land for front of plenty top […]

todayAugust 1, 2026 17

OBODO NAIJA

Peter Obi Burst Out Over Hunger Wahala, Say Nigerians Don Tire For Suffering

By: Esther Daniel NDC presidential candidate Peter Obi don raise alarm over hunger and insecurity for Nigeria, say oga Presido Bola Tinubu-led APC gornment never do enough to fix di serious problems wey dey face Nigerians. Obi drop di heavy words during funeral service for late Okaji Simon Okorie Abaa for Isiama, Ebonyi State, where crowd gather as he charge Nigerians to stand strong and defend dia votes for 2027. […]

todayJuly 31, 2026 11

OBODO NAIJA

Kenneth Okonkwo Tell Tinubu Say INEC Never Prove Dia Self

By: Esther Daniel ADC big man Kenneth Okonkwo don blast oga presido  Bola Tinubu over him defence of INEC, say di electoral body never prove to Nigerians say dem dey fair and neutral. Okonkwo react after Tinubu talk am on Tuesday during meeting with Catholic Bishops for State House, Abuja, where di presido defend di commission. Tinubu insist say INEC still dey independent and say people wey dey question dia […]

todayJuly 31, 2026 11

National

Oga Presido Tinubu Vow Justice As Gunmen Kill 30 People For Kaduna

By: Esther Daniel Wi oga Presido Bola Tinubu don cut chain oh say make wi security look for way go gbab di jaguda boys wey go kpai about 30 innocent residents for Naridon Village, Kauru Local Government Area of Kaduna State. Special Adviser Bayo Onanuga wrap dis one for message on Tuesday, dat di gun scarra di community for hours, no going, no coming. Di dangerous attackers kpai kpai mostly […]

todayJuly 28, 2026 12

OBODO NAIJA

Obi Ginger Oga Presido Tinubu To Dey One Side For Beta Leader To Rule Naija

By: Esther Daniel Labour Party presidential candidate for 2023 election, Peter Obi, don blast Presido Bola Tinubu again, say make wi presido step aside dat im nor get di doings to solve naija security wahala. Obi yarn dis one for tv sitdown tuk on sunday, dat baba need rest oh. E still tok say no mata how many governors support Tinubu for 2027 election, na hungry and suffering Nigerians go […]

todayJuly 27, 2026 14

National

Fubara Declare Support for Rainbow Coalition, Tinubu

By: Esther Daniel Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, don declare support for Rainbow Coalition, di political group wey FCT Minister Nyesom Wike dey lead for Rivers State. Fubara tok dis one during di groundbreaking ceremony for Riven Medical Facility, where e also confirm President Bola Tinubu as im preferred presidential candidate and Kingsley China as im choice for governor for 2027 election. Di governor tell all im supporters make dem […]

todayJuly 22, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds