Di election breeze take dey blow nor be small, group just dey do alignment support group up and down, na so yesterday one women political group wey call demselves Nigerian Women for Tinubu/Shettima 2027 (NWFTAS 2027), go promise re-election for Tinubu/Shettima ticket inside Aso rock.
For una wey never get voter card, oyo na your case oh, women dey play front for Abuja like dis like dis.
Senior man vice presido, Shettima kon also promise hin own in return say Baba Presido, Bola Tinubu gornment dey fully ready to empower women.