ELECTION

28 Results / Page 2 of 4

Background

Politics

First Lady Back GAC Choice of Hamzat

Nigeria First Lady, Senator Oluremi Tinubu, don receive Lagos Deputy Governor, Dr Kadri Obafemi Hamzat for Abuja. Dem present Hamzat to her on Thursday as All Progressives Congress consensus governorship candidate by Lagos Governance Advisory Council (GAC), led by Prince Tajudeen Oluyole Olusi with Governor Babajide Sanwo-Olu and other party leaders. Oluremi Tinubu talk say she dey happy with di decision, compare am to electoral college system, and praise Lagos […]

todayApril 30, 2026 25

Politics

Jandor Pull Out For Lagos Governorship Race

Di 2023 Pipos Democratic Party Lagos state governorship candidate, Dr Abdul-Azeez Adediran, AKA Jandor, don withdraw from Lagos 2027 governorship race. E tuk dis one on Thursday for news conference, say e dey follow President Bola Tinubu endorsement of Deputy Governor Obafemi Hamzat as APC consensus candidate. Jandor, wey be Lagos4Lagos Movement leader, explain say dem don earlier agree to support whoever party choose, so e decide to step down. […]

todayApril 30, 2026 22

National

Makinde, PDP Faction Waka Go See ADC For Abuja To Show Support

Oyo State Governor, Seyi Makinde, together with some members of di Turaki-led faction of di Peoples Democratic Party (PDP), don waka go see African Democratic Congress (ADC) leaders for Abuja. Makinde talk say di visit on Wednesday na to show support for ADC leadership and to discuss matter wey dey affect Nigeria democracy. According to Makinde, dem come through consultation and solidarity to help strengthen democratic process for Nigeria.

todayApril 9, 2026 21

Politics

Oyo 2027, Makinde Set Mission To Choose Successor For 2027

Oyo State Governor Seyi Makinde on Sunday, for Ibadan, Oyo State say like dis now im don start process to choose who go succeed am for 2027 election. Di senior put for letter wey dem give tori pipo, say dem don involve credible people to make sure di transition smooth and fair, and im go make di announcement later. Makinde explain say, im don task im advisory council, led by […]

todayApril 6, 2026 24

OBODO NAIJA

ADC Put Call For INEC Chairmo Sack

African Democratic Congress (ADC) chairmo, David Mark, don call make dem sack INEC chairmo, Prof Joash Amupitan say, im nor know im work. E run dis one for one join body press conference wey dem run for Abuja yesterday, say INEC dey bias. According to David Mark, moral dey very, very, low, say Nigerians nor get confidence for Amupitan and all di national election, commissioners.

todayApril 3, 2026 23

Politics

APC Resume Dia E-registration System, PDP Claim 4.2 Million Members

APC don resume dia registration doings even as politics don dey hot. APC tuk tuk, Felix Morka, for statement on Wednesday announce am say, dem don resume electronic registration for all wards and approved spots nationwide. E tell old members make dem go confirm dia membership, and new people make dem rush join di party sharp sharp. But for PDP side, one faction wey Tanimu Turaki lead, and Seyi Makinde […]

todayApril 2, 2026 20

OBODO NAIJA

ADC, PDP, Obi Blast INEC As Dem Drop David Mark, Aregbesola Recognition

Di African Democratic Congress, Peoples Democratic Party, and Peter Obi dey vex wetin nor good for  INEC say dem  remove David Mark, Rauf Aregbesola and some other party leaders from recognition. INEC tuk say dem take dis decision because of court order wey say make dem maintain status quo until dem settle case about David Mark leadership. ADC tuk, tuk Bolaji Abdullahi and PDP own Ini Ememobong say dis action […]

todayApril 2, 2026 21

OBODO NAIJA

Kaduna North, South Join Body To Back Bola Tinubu, Uba Sani For 2027

Former Kaduna Central senator Shehu Sani talk say Kaduna North wey be mostly Muslim and South wey be mostly Christian don join body under one political party for di first time since 1999. E yarn dis one after Imself, Abbas Tajudeen and Sunday Marshall visit Bola Tinubu for Aso Rock. According to am, di unity na because of wetin Uba Sani and Tinubu don achieve, and both North and South […]

todayApril 2, 2026 20

OBODO NAIJA

Tuggar Dump Foreign Affairs Job, Set Eye for Bauchi Governor Seat

Oga Minister of Foreign Affairs, Ambassador Yusuf Tuggar don resign from im position to follow im political plan to run for Bauchi State governor. Di ministry tuk tuk, Kimiebi Ebienfa, na im dey konfamate di resignation on Monday. Before now, report bin don show say Tuggar dey among four ministers for President Bola Tinubu cabinet wey go resign to pursue political ambition. Even di minister media aide, Alkasim Abdulkadir, don […]

todayMarch 30, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds