IRAN

45 Results / Page 3 of 5

Background

obodo oyinbo

Iran Clear US Dat Dia Hand Nor Go Dey Any Deal Wey Nor Go Respect Iran Right

By: Esther Ayoola Iran chief tuk, tuk person, don declare say dem no go accept any deal with United States unless e fully protect rights of Iranian pipo. According to report, Donald Trump bin send tougher new proposal go back to Tehran. For di Iran pipo, dat any change for di agreement wey nor follow go spoil everytin and di Strait of Hormuz go remain close, dis one mean say […]

todayJune 1, 2026 14

obodo oyinbo

US Senate Move To Block Trump From Carry Military Action Against Iran

By: Esther Ayoola United States Senate don advance tuk on how to control War all to stop Donald Trump from using military force against Iran without Congress approval. Dem do di voting on Tuesday, say some of trump party mehn sef join Democrats support di move. Di US senators also express concern say di way di war dey go for Iran dem nor understand again oh, even with ceasefire for […]

todayMay 20, 2026 11

obodo oyinbo

US Fit No Accept New Iran Peace Proposal – Donald Trump

Donald Trump talk on Saturday say e go check new peace proposal wey come from Iran, but e still show doubt whether di deal go work, as e no close door for possible fresh attack on Iran. Peace talks between United States and Iran don jam for ground since ceasefire start on April 8. One round of peace talks wey happen for Pakistan to end di war wey don pass […]

todayMay 3, 2026 19

obodo oyinbo

Iran Tankers Still Dey Pass US Blockade For Hormuz

According to Financial Times report on Wednesday, at least 34 tanker ships wey get link to Iran still dey waka pass Strait of Hormuz for recent days, even though US dey block di Strait. But US Presido, Donald Trump sti talk say America “fully control” di Strait of Hormuz, and claim say di blockade strategy dey work well well. On April 13, US put blockade wey dem talk say go […]

todayApril 23, 2026 22

obodo oyinbo

Iran Military Make Move To Block Red Sea, Gulf Trade After U.S Naval Blockade 

Iran military don sama warning say dem go block trade for Red Sea, Gulf, and Sea of Oman if US naval blockade on Iranian ports continue. Military commander Ali Abdollahi and Iran central command na im tuk dis one for State broadcast. According to di senior men, US dey create cause problem  for Iran ships and oil tanker movement, and dis sef violate dia ceasefire agreement. Military commander Ali make […]

todayApril 16, 2026 26

obodo oyinbo

Middle East Wahala Grow As Trump Start Hormuz Blockade

US blockade for Iran ports don start for Strait of Hormuz, as Donald Trump dey insist say, im still get space for Peace deal. Im put dis one for im Truth social on Monday. However, Iran on di other hand  dey accuse US, say na piracy dem dey do for di Strait of hormuz, as plenty pipo dey protest di mata for Tehran.

todayApril 14, 2026 15

obodo oyinbo

Iran and US Tuks Fail

Iran and United States no reach deal to stop Middle East war, as US Vice President JD Vance talk after long talks for Islamabad, say e don drop im “final and best offer” give Tehran before e comot. Vance say US want clear promise from Iran say dem no go build nuclear weapon, but dem never see dat commitment. Pakistan wey host di talks urge both sides make dem respect […]

todayApril 12, 2026 19

obodo oyinbo

US Vice Presido Land Enter Pakistan For Iran Talks

US Vice Presido, JD Vance land for airbase near Islamabad on Saturday, ahead of negotiation with Iran to end Middle East war. Iran delegation wey pass 70 people, wey parliament speaker Mohammad Bagher Ghalibaf lead, reach Islamabad first under tight security. Di Vice presido yarn say US dey ready to open hand if Iran negotiate well, but if dem wan play game, US team no go soft. As for Iran […]

todayApril 11, 2026 21

obodo oyinbo

Presido Trump To Touch Light Iran Ceasefire Deal

White House officials, all di way from united state of America on Monday don konfamate say dem dey consider one 45-day ceasefire deal between U.S. and Iran for di Middle East war. Di senior men wey tuk with Agence France-Presse, say di only tin be say Donald Trump never sign di deal. Dem explain say na mediators bring di proposal as part of efforts to reduce di fighting, but Trump […]

todayApril 7, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds