Lagos state

83 Results / Page 2 of 10

Background

Lifestyle

Kemi Adeosun Husband Don Die for Lagos

By: Jolayemi Olajide   Anthony Adeosun, husband of former Finance Minister Kemi Adeosun, don die at di age of 62 after e pass away on Wednesday for Lagos State. Di Adeosun family announce di sad news on Thursday through statement wey Reverend C. A. Adeosun release on behalf of di family. According to di statement, Anthony Adeosun die on August 5, 2026, but di family no talk wetin cause im […]

todayAugust 6, 2026 15

Lagos

Lagos Open New Workshop To Boost LNSA Security Operations

  By : Jolayemi Olajide Lagos State don commission new Lagos State Neighbourhood Safety Agency (LNSA) Technical and Mechanical Workshop for Ijede, Ikorodu, to improve maintenance of patrol vehicles, motorcycles and security equipment. House Committee Chairman on Information Strategy and Security, Hon. Stephen Ogundipe, praise Governor Babajide Sanwo-Olu and LNSA General Manager, Prince Dr. Ifalade Oyekan, say di project go strengthen security operations and improve emergency response. Ogundipe tok say […]

todayAugust 6, 2026 13

Lagos

Fire Burn Houses For Yaba, No Life Lost

By: Olabisi Olatunji Lagos State Gornment say no life lost after fire destroy cluster of makeshift houses for Abule-Oja, Yaba, on Wednesday. Di fire happen for Abudu Street by UNILAG Road before emergency agencies quickly respond. Firefighters and security operatives work together to stop di fire from spreading to nearby buildings. Lagos State Fire and Rescue Service, Federal Fire Service, UNILAG Fire Service, Police and LNSC join fight di inferno.

todayAugust 5, 2026 15

Lagos

Sanwo-Olu Hail Badejo Okusanya As She Become 33rd NBA President

By: Esther Daniel Lagos State Govo Babajide Sanwo-Olu done congratulate Senior Advocate Oyinkansola Badejo-Okusanya on Monday after she emerge as di 33rd President of di Nigerian Bar Association. Sanwo-Olu call her victory big history inside one official statement as she become only di second woman to lead NBA. Di govo praise di SAN say dis high position na correct reward for her long years of dedication to legal work. E […]

todayJuly 28, 2026 19

Lagos

NSCDC Burst Fake School, Rescue 106 Youths For Badagry

By : Jolayemi Olajide NSCDC don burst one alleged fake university wey dey run from one three-bedroom flat for Ilado, Badagry, and rescue 106 youths wey dem allegedly use fake foreign school admission package carry enter trap. Di operation happen early Monday after security people monitor di place for days, as dem arrest di man wey dem say na im own di fake school. According to NSCDC, di suspects dey […]

todayJuly 21, 2026 18

Lagos

Lagos Gornment Explain How Heavy Rain Take Wound Lagos Roads

By: Esther Daniel Lagos State Public Works Corporation don beg residents make dem get patience as di long rainy season don cause serious flood and spoil many roads and public facilities for different parts of di state. Di agency tok say di bad roads don make movement hard for motorists, commuters and other residents, but dem dey work round the clock to repair roads and make dem safe for use. […]

todayJuly 17, 2026 15

Lagos

Lagos Deploys Swamp Buggy To Fight Flooding For Ogombo Communities

By: Yusuf Abuh Lagos State Gornment don send swamp buggy go Ogombo canal for Eti-Osa Local Government Area to help reduce flooding caused by heavy rainfall across parts of di state. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, reveal dis on Thursday through him X handle after inspecting flood-affected areas for Eti-Osa and Ibeju-Lekki. E explain say di machine don start clearing and removing dirt from di drainage channel […]

todayJuly 17, 2026 18

Lagos

Lagos Gornment Vow To Continous Demolition Of Shanties Along Badagry Expressway

By: Yusuf Abuh Di Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, announce on Monday say Lagos State Gornment go continue to scatter all illegal structures dem along di Lagos-Badagry Expressway. Senior man Wahab drop dis informate, say, dem nor allow any kin person con scata work wey dem don dey do for di past three weeks, any illegal structure must go ground, so dat di environment go dey ok […]

todayJuly 13, 2026 17 2

Lagos

Lagos Govment Query Environmental  Officer Wey Collect 20,000 Bribe

By : Jolayemi Olajide Lagos State gorment don query one environmental  officer wey video show as e dey collect 20,000 bribe from one environmental law breaker. Environment commissioner, Tokunbo Wahab, tok dis one on Friday through him X page. Di incident happen for lagos state after di video go viral for social media. Dem don set to investigat di matter and anybody wey get fault go face disciplinary action.

todayJuly 10, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds