Lagos state

83 Results / Page 3 of 10

Background

Lagos

Federal Gornment To Scatta Tins To Build Gutters For Lagos Coastal Highway

By: Yusuf Abuh Wi Minister of Works, Dave Umahi, don spill out new plans to stop Lagos flooding for di Lagos-Calabar Coastal Highway, say dem one build new gutters. Umahi tuk dis one meeting with stakeholders for Lagos say,  dem joinbodi with di lagos gornment build service lanes. He explain say dis new plan na long-term arrangement to put end to di flood problem wey heavy rainfall dey always cause […]

todayJuly 8, 2026 12 1

Lagos

LASEMA Yarn Say No Building Collapse For Alakija

Di Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) don officially clear bad air wey dey spread for social media say one building collapse for Alakija area. LASEMA Permanent Secretary, Dr. Olufemi Oke-Osanyintolu, konfamate dis for statement on Thursday say di report na lie and e dey mislead di public. Officials wey dem send to check di area after di news show face no find any evidence of any building collapse for […]

todayJuly 2, 2026 7

Lagos

Sanwo-Olu Order Gutter Cleaning To Clear Lagos Flood

By: Yusuf Abuh Lagos State Gornment don beg residents make dem calm down after heavy rain cause ogbonge flooding for many parts of di state in di last two weeks. Gofnor Babajide Sanwo-Olu like dis don approve immediate cleaning for 28 water channels to help reduce flooding. Oga Commissioner of Environment, Tokunbo Wahab naim explain dis mata give tori pipo o Tuesday, say na heavy rain wey fall for places […]

todayJuly 1, 2026 17

Lagos

Demolition Loading As Lagos Gornment Vow To Clear Illegal Structures

Lagos State Gornment based on flooding don sama beta warning say dem go bring down any shop, or building wey dey block gutters flows for Ajiran, and Ikota areas sharp. Di Commissioner for Environment and Water Resources,  Tokunbo Wahab, tuk dis one after im go check di gutter systems for Lekki and those areas, say na dis blockade dey make flooding dey hapun for raining season. Wahab warn developers say, […]

todayJune 29, 2026 11

Lagos

Lagos Assembly Hail Gofnor Sanwo-Olu For Him Birthday

Nor be small doings for di Lagos State House of Assembly, betalicious owambe, say di Govo, Babajide Sanwo Olu, wey be di number one man of di state, dey mark im 61st birthday celebration. Chairmo of House Committee on Information, Strategy and Security, Hon. Stephen Ogundipe, na him tok dis one ehn, on behalf of Speaker Mudashiru Obasa, principal officers and oda lawmakers. Dem hail di senior man wetin nor […]

todayJune 25, 2026 12

Lagos

Lagos SSG Tell LG Secretaries To Focus On Grassroots Development

By: Yusuf Abuh Lagos State Government don drop micro soft word say make local gornment secretaries for South-West region try do grassroots development, for mehn to feel dem Secretary to di Lagos State Government, Bimbola Salu-Hundeyin, naim give di advice on Wednesday when she receive members of di South-West Forum of Secretaries to di Local Gornments during a courtesy visit for Lagos. She say local government secretaries dey play important […]

todayJune 25, 2026 29

Lagos

Lagosians React To Sanwo Olu

At first when oga Govo, Babajide Sanwo Olu bringing back di monthly sanitation for Lagos, everywia first blur like say, e first be like say na play, play Months don pass  now and e dey belike like many pipo don dey get use to latest cleaning, why Konfam news tatafo Jolayemi Olajide and her crew enta street of Lagos to know how di every month sanitation package dey be dem.

todayJune 24, 2026 17

Lagos

Lagos Gornment Close Oshodi Market

By: Yusuf Abuh Lagos State Gornment don shut down, close everywia for Oshodi Resettlement Market say some jaguda pipo go attack sanitation enforcement officers during operation. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, naim put dis one for statement on Tuesday, say di traders for di market block officers from doing dia work. According to am, di environmental sanitation officers bin dey carry out operation to arrest street beggars […]

todayJune 24, 2026 14

Lagos

DIG Fayoade Call For Body Camera For Police To Boost Accountability

By: Yusuf Abuh Di Deputy Inspector-General of Police in charge of di Southwest zone, Adegoke Fayoade share beta security doings say make police officers begin wear cameras for body bring beta professionalism for Nigeria policing. E make dis appeal during im visit to Lagos State Security Trust Fund office as part of im tour across Southwest states. Fayoade nor hide mouth tuk say Lagos dey very important for national stability […]

todayJune 23, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds