Lagos

54 Results / Page 4 of 6

Background

Lagos

Lagos SSG Tell LG Secretaries to Focus On Grassroots Development

Lagos State Government don drop micro soft word say make local gornment secretaries for South-West region try do. grassroots development, for mehn to feel dem Secretary to di Lagos State Government,  Bimbola Salu-Hundeyin, na im give di advice on Wednesday when she receive members of di South-West Forum of Secretaries to di local gornment during a courtesy visit for Lagos. She say local gornment secretaries  dey play important role because […]

todayJune 25, 2026 34

Sports

Ogundinran Win 100m Gold for Lagos Trials

By: Yusuf Abuh   Unto di commonwealth trail for Lagos, Blessing Ogundinran wey base US naim collobi n women 100m title for 2026 Commonwealth Games National Trials for Lagos, as she run 11.12 seconds to become Nigeria new national champion. She beat young athlete Miracle Ezechukwu wey follow close behind with personal best of 11.15 seconds, while Olajide Olayinka come third with 11.28 seconds. Di race happen for Lagos and […]

todayJune 23, 2026 21

Lagos

History Happun For Lagos House Of Assembly

Nor bi small History hapun yesterday for Lagos State House of Assembly as dem swear for dia first female clerk to run di affairs of di house. Di Speaker, Right Honourable Mudashiru Obasa, na im coordinate di swearing-in ceremony of Adenike Abolanle Oshinowo, wey break record as di first-ever woman to hold dis position since dem create di Assembly.

todayJune 23, 2026 18

Lagos

Police Explain Wetin kpai DCP Khan Salihu

Lagos State Police Command don clear air say story wey bin dey fly say late DCP Khan Salihu dem kidnap before im kpai na fat lie from di pit of hell. Police tuk tuk, SP Abimbola Adebisi, explain for statement, say di officer just complain say e no dey well, dem rush am go hospital, naim doctor konfam say e don kpai. Police tuk say di report na fake news […]

todayJune 17, 2026 29

Lagos

Lagos Council Chairmo Appoint Mehn To Rascal Rascality

Chairmo of Igbogbo/Baiyeku Local Council Development Area, Hammed Aroyewun, don vow say dem go continue raid criminal hideouts for di area. E talk dis one on Monday as e dey brief journalists for council secretariat. E also talk say security operatives recently carry out surprise operation for one suspected black spot, wia dem recover hard drugs and other illegal items. According to am, di raid come as result of intelligence […]

todayJune 16, 2026 40 14

Lagos

Lagos Residents Cry Out Say Dirty Dey Smell

Plenti residents for Ikotun, Idimu, Ejigbo and Egbeda area of Lagos don cry out say dirty dey smell dem despite gornment effort to clear waste. Lagos Waste Management Authority bin say dem remove 418,500 tonnes of dirty for across di state for May, wey average 13,200 tonnes every day. According to aproko pipo wey go touchlight one Industrial chemist, Harrison Chinaka, say dirty for Alimosho area dey wey fit cause […]

todayJune 15, 2026 17

Lagos

Lagos Barbar Pursue Guiness World Record

Say like dis Guinness world record, dey monitor one 24-year-old hairstylist, Ikechukwu Damilola wey dem dey call “Transformation King,” wey wan break world record, say im don reach 90 hours out of 120-hour to break Guinness World Record hairdressing marathon for Lagos. Di attempt dey happen for Oto-Awori Local Council Development Area for Ijanikin and GWR officials dey monitor am. Chairmo of di LCDA, Mr. Kareem Abiodun, talk say di […]

todayJune 15, 2026 16

Lagos

Lagos Clean Up With International Mehn

Clean lagos, clean lagos, u dey feel say na play play, yesterday, lagos environmental pipo cary some senior mehn, show dem shegge, tell dem to clean. Dis na mehn wey dey in charge of international exchange, an dem  carry di senior exchange pipo go clean lagos Marina, to mark World Environment Day 2026. Di programme hapun in collabo with Lagos State Waste Management Authority and Recyclers Association of Nigeria to […]

todayJune 12, 2026 18

Lagos

IKOSI-KETU Pipo Cry Out Over Cost of Living

Normally na di duty of every gorment of a country to balance tins, for citizen to survive, however e be like water don pass garri for obodo Nigeria. Complain here and there, unto di rising cost of living, konfam news tatafo, Esther Ayoola enter di street of Lagos, to tell us, how Lagos dey cope with di new cost of living.

todayJune 11, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds