Lagos

50 Results / Page 2 of 6

Background

Lagos

Lagos Police Bust Fake Drug Warehouse

Lagos State Police Command say dem don bust two warehouses  wia pipo dey repackage fake drugs, and arrest two suspects. Police Commissioner Fatai Tijani naim package dis mata one on Monday during press tuk, tuk doings inside Violent Crime Response Unit, Ijora Olopa, Lagos. Di two suspects, Eze Okwudilichukwu, 52, and Chukwudi Mba, 42, naim dem catch dem for one warehouse along Otto Causeway, Otto, Lagos, where police say dem […]

todayAugust 4, 2026 10

Lagos

Frank Edoho Call Lagos House Property Armed Robbery On Monday

By: Yusuf Abuh Popular media personality Frank Edoho blast Lagos house sellers during one show broadcast on Monday because dem dey sell house too cost. Edoho talk dis matter inside Lagos on Monday through di video show to ask who get money buy house as naira dey fall. Di veteran host complain for Lagos on Monday during di talk show because dem dey sell one house for Osapa $1.5 million […]

todayAugust 3, 2026 11

Lagos

Police Gbab Suspected Armed Robber for Lagos

Lagos State Police Command don arrest one 29-year-old man wey dem suspect say na armed robber during routine patrol on Wednesday for Igando area of Lagos. Police tuk, tuk person, SP Abimbola Adebisi, naim konfamate dis one say officers sight three men wey dey ride one motorcycle and dey behave funny and na so dem take follow dem up. She say as di suspects see police, dem try run, but […]

todayJuly 30, 2026 40 1

Lagos

Lagos Dey Plan Special Number Plates For Pipo Wey Get Disability

Lagos State Gornment don begin plan to introduce special vehicle number plates for people wey get disability, so movement fit easier and everybody fit enjoy equal access across di state. According to statement from di state gornment, Lagos State Office for Disability Affairs, LASODA, and Lagos State Motor Vehicle Administration Agency, MVAA, na dem dey work together to bring di plan to life. Di idea come after LASODA management visit […]

todayJuly 29, 2026 14

Lagos

Lagos Tighten Safety Rules for High-Rise Buildings

Lagos State Gornment don carry mata for head  dey hawk Lagos problem, say, di way building take collapse don too much, and like dis na to “protesion” every every for di obodo Lagos naim be di goal. Small tin, person go hear, one building don collapse, if nor be building na fire as dem ginger all lagosians to dey very careful with dia safety. Na di oga kpatakpata, Director-General of […]

todayJuly 29, 2026 15

Uncategorized

Gas Tanker Catch Fire For Ikotun, No Life Lost

By: Yusuf Abuh One gas tanker catch fire early Thursday morning for Abaranje Road, Ikotun, Lagos State, but nobody die or get injury because emergency workers quickly reach di scene. Lagos State Emergency Management Agency tok for statement on Thursday say firefighters and other emergency workers stop di fire before e spread to nearby houses and shops. LASEMA spokesman Olawale Afolabi say early findings show say di tanker dey move […]

todayJuly 23, 2026 12

Lagos

Lagos Gornment Explain How Heavy Rain Take Wound Lagos Roads

By: Esther Daniel Lagos State Public Works Corporation don beg residents make dem get patience as di long rainy season don cause serious flood and spoil many roads and public facilities for different parts of di state. Di agency tok say di bad roads don make movement hard for motorists, commuters and other residents, but dem dey work round the clock to repair roads and make dem safe for use. […]

todayJuly 17, 2026 12

Lagos

Bad Smell, dirty Trouble Oshodi As Residents beg gornment for  Action

By : Jolayemi Olajide Residents, traders and commuters for Oshodi, Lagos, don raise alarm say dirty dey smell dem for di area despite baba Govo, Babajide Sanwo-Olu order to increase waste evacuation across di state. New tatafos reach di  Oshodi Bus Terminal area, show plenty dirty dey cover roadside, walkway and part of the road, with bad smell wey dey smell everybodi Some traders complain say di waste don stay […]

todayJuly 15, 2026 11

Lagos

How Unknown Gunmen Kpai Lagos transport Secretary, Ijaya

By : Jolayemi Olajide Nor be small tin oh, Lagos National Union of Road Transport Workers, NURTW Organising Secretary, Toba Ajiboye, wey people know as Ijaya wey do lose im life after unknown gunmen attack am for Ikorodu Road. Report say the gunmen block im motor for night as e dey return from Fadeyi, come open fire and scatter the motor with bullets. Though first report talk say Ajiboye survive […]

todayJuly 14, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds