Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu, don talk say APC don ready well-well for di 2027 general election, as e dey confident say di party go carry victory for Lagos.
Sanwo-Olu talk dis one on Monday after e waka go inspect APC presidential and gornorship campaign offices to see how preparation for di election dey go.
Di Govo say di party campaign structure don dey set, as dem don start to dey plan and mobilise pipo ahead of di election.
E say APC presidential candidate, Presido Bola Ahmed Tinubu and Lagos gornorship candidate, Dr Obafemi Hamzat, and other APC candidates don fully enter di campaign work.