UNITED STATES

25 Results / Page 2 of 3

Background

obodo oyinbo

Netanyahu, Trump Meet Again As Iran War Tension Shake Their Relationship

By: Esther Daniel Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu go meet US President Donald Trump for talks at di White House on Tuesday, as both leaders try to manage issues from di Iran war wey don cause disagreement between dem. Di meeting go be dia first face-to-face discussion since di war with Iran started, as both leaders dey look for way to handle di situation. Relations between Netanyahu and Trump don […]

todayJuly 28, 2026 29

obodo oyinbo

Trump Yarn Say Iran Money Go Pay for Hormuz Ship Gbege

United States Presido, Donald Trump don tok say any damage wey happen to ships and cargo for Strait of Hormuz ehnnn, na frozen Iran money go pay for am. For post wey e make on Truth Social on Thursday, Trump tok say na Iranian money wey America hold go take settle any damage. Trump still tok say America don carry out 13 nights of strikes on Iran, and say e […]

todayJuly 24, 2026 19

obodo oyinbo

Iran Warn America: “Touch Hormuz Again, We Go Hit Back”

By : Jolayemi Olajide Iran on Thursday warn say Strait of Hormuz no be something to bargain with, saying if America increase military attack, dem go strike important facilities across Gulf region. Di warning come after five straight nights of US military operations and fresh naval blockade around Iranian ports, following Iran decision to close Strait of Hormuz last Saturday. Iran top official, Mohammad Baqer Qalibaf, describe di fight with […]

todayJuly 16, 2026 22

obodo oyinbo

US Dash Saudi $1.96bn Weapon Package

United States don approve $1.96 billion weapon package giv Saudi Arabia on Wednesday, make e boost im air defence, as war for Middle East dey become more serious. For inside statement, di US State Department talk say di $1.96 billion weapon package no be just to arm Saudi, but to make am one of America strongest padi for di Gulf region. Dis move come as Iran-backed Houthi fighters fire missiles […]

todayJuly 16, 2026 23

obodo oyinbo

Iran declare Say Hormuz Strait Go Remain Closed,

BY Esther Daniel Iran Revolutionary Guards don warn say Hormuz Strait go remain closed until the United States stop wetin dem call "acts of aggression" against Iran. The group also threaten say other oil and gas export routes for the region fit become target if the fighting continue. Since the clash between America and Iran start for late February, movement of oil and gas through Hormuz Strait don suffer serious […]

todayJuly 15, 2026 23

obodo oyinbo

Iran Warn US & Israel As 20 Million Pipo Gather For Khamenei Burial

Iran top negotiator don sama warning say, if US and Israel refuse to end di war as dem promise, Iran go change am for dem. Dis warning dey come as over 20 million pipo gada  for Tehran for di burial of former Supreme Leader Ali Khamenei, wey kpai follow im family members since di war start. Iran army commander self done swear say dem must revenge di blood of Ayatollah […]

todayJuly 3, 2026 21

obodo oyinbo

Iran Clear US Dat Dia Hand Nor Go Dey Any Deal Wey Nor Go Respect Iran Right

By: Esther Ayoola Iran chief tuk, tuk person, don declare say dem no go accept any deal with United States unless e fully protect rights of Iranian pipo. According to report, Donald Trump bin send tougher new proposal go back to Tehran. For di Iran pipo, dat any change for di agreement wey nor follow go spoil everytin and di Strait of Hormuz go remain close, dis one mean say […]

todayJune 1, 2026 27

obodo oyinbo

US Wan Rush Comot Americans From Hantavirus Ship

United States don talk say dem dey arrange evacuation flight to carry Americans wey dey inside one cruise ship wey hantavirus don affect, as di ship dey head go Canary Islands. According to one spokesperson from di U.S. State Department, government dey work to make sure say all American passengers return home safely. Dem also talk say dem dey cooperate with government of Spain and other U.S. agencies to handle […]

todayMay 9, 2026 24 2

obodo oyinbo

Cuba And US Hold Respectful Tuk For Havana To End Oil Blockade

By: Esther Ayoola Cuban gornment don konfamat on Monday for Havana say, dem hold tuks with United States officials as tension sti dey between both countries over US energy and oil blockade for Cuba. Deputy director general for US affairs for Cuba Foreign Ministry, Alejandro Garcia del Toro, naim dey konfam dis mata say US delegation include assistant secretaries of state, while Cuba side send deputy foreign minister level pipo […]

todayApril 21, 2026 26

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds