Wi oga Presido Bola Tinubu don tell Nigeria new ambassadors and high commissioners say make dem work hard to improve how world pipo go dey see Nigeria.
Di Presido tuk dis one on Monday for induction programme wey hapun for Ministry of Foreign Affairs for Abuja.
George Akume, wey be Secretary to di Gornment of di Federation, na im represent am tuk for dis event.
E still ask dem to bring foreign investors come and build beta partnerships for di country.