Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di gbege happen just 24 hours after Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) do summit on how to handle emergency wahala for di state. For statement wey dem drop on Wednesday, LASEMA Permanent Secretary, Olufemi Oke-Osanyintolu, confirm di kasala. He talk say di fire for Bariga Market start around 4 a.m. and e waka fast go round di market before emergency people show face. Oke-Osanyintolu yarn say as dem reach di scene, dem find out say di fire begin from one shop, but because di shops na key–clamp type and dem use wood take divide and support dem, di fire just waka fast enter other shops. He talk say before emergency people land, plenty shops don already full with fire. But e still talk say dem later manage control di fire, thanks to all di emergency teams wey join body stop am from spreading go other parts of di market.
Oke-Osanyintolu talk say na joint work of emergency responders help quench di fire sharp-sharp and stop am make e no spread go other side of di market. Dem manage di scene well to make sure say no wahala happen again after di fire. Even though dem never sabi wetin cause di fire, im confirm say nobody die and nobody wound. LASEMA damage report show say 26 key-clamp shops burn down, and people lose property wey worth millions of naira. Plenty of di traders wey rush come market after dem hear say fire don happen, begin cry seriously as dem dey look how dia goods take burn finish. One of di traders wey no gree mention im name tell talk say: Na everything I get be dis. All my sweat don burn finish. I no even know where I go start from again. dis fire wey happen on Wednesday na still part of di many fire wahala wey don dey happen for Lagos recently.
Written by: News Editor 2
LAGOS MARKET FIRE SHOP OWNERS COUNT LOSSES
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025