By: Esther Ayoola
Na God save two pipo afta one serious motor askident hapun today for Ogudu-Alapere area of Lagos.
Dat one danfo and one big truck jam each oda ikpaaii.
According to Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA), na one 12-tyre DAF truck and Volkswagen T4 danfona get di askident.
LASTMA officials wey dey patrol naim go di area, rescue di victims and control traffic movement to prevent more damage and restore free flow of traffic.