By: Esther Ayoola
United States don warn say terrorist groups like ISIS don dey move dia operations enter West Africa and Lake Chad Basin afta dem drive dem for Iraq and Syria.
For one new counterterrorism strategy document, na US take tuk dis tuk, say places like Naija, Sahel region, Mozambique, Sudan and Somalia don see fresh increase for terrorist attacks.
According to di report, ISIS fighters and other jihadist groups dey use weak security and areas wey gornment nor dey in control take regroup for Africa and Central Asia.
US say one of dia main goals for Africa na to stop extremist groups from building strong bases wey fit threaten American interests.