obodo oyinbo

US Plan Ground Attack On Iran Even As Talks Still Dey Go On — Iranian Speaker Yarn

todayMarch 29, 2026 5

Background
share close

Iran parliament speaker, Mohammad Bagher Ghalibaf, don blast say US dey plan ground attack coded, even as dem dey form say dem wan do peace talk.

E talk say enemy dey shout negotiation for outside, but lowkey dem dey arrange ground attack.

E still yarn our soldiers dey wait make US troops show face, make dem roast dem and deal with dia  allies finish.

Dis gbege start since Feb 28 when US and Israel bomb Iran, kill dia top leader, con spark war wey don scatter Middle East.

Strait of Hormuz wey dey carry like 20% of world oil don almost lock because of di fight.

Ghalibaf come tell Iranians make dem stand gidigba, say dis war don reach serious level.

E swear say dem go make US regret am well well and protect dia right with full chest.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app