By: Esther Ayoola
Iran Presido, Masoud Pezeshkian on Tuesday say im don ready to start tuks wit United States, if only di tuk nor go bring problem to Iran.
US Presido, Donald Trump, bin warn Iran say “bad things go hapun” if Iran nor strike Nuclear deal with dem.
Arab official wey no give im name, say dem fit meet for Turkiye on Friday for di tuks, as Egypt, Qatar, Oman and Turkiye dey try hellep settle di mata.
Pezeshkian say, di tuks must protect Iran national interests and follow diplomatic channel from friendly governments.