According to Financial Times report on Wednesday, at least 34 tanker ships wey get link to Iran still dey waka pass Strait of Hormuz for recent days, even though US dey block di Strait.
But US Presido, Donald Trump sti talk say America “fully control” di Strait of Hormuz, and claim say di blockade strategy dey work well well.
On April 13, US put blockade wey dem talk say go “totally jam” all sea trade wey dey enter and comot Iran, including ships wey carry things wey fit support Iran for war against US and Israel.
So far, na only one container ship dem detain for Gulf of Oman, plus one sanctioned tanker wey US forces board for Indo-Pacific area.