By: Esther Ayoola
Oneman wey dem call Olalowo Olatunji, wey be 44 years old, don collect 24 months jail sentence for Federal High Court wey dey Lagos.
Justice Ambrose Lewis-Allagoa give di judgement afta di man admit say im guilty for two-count charge wey NDLEA bring come court.
NDLEA tuk say dem arrest am on March 8, 2026 for Victoria Island as e dey sell 89 grams of cocaine and 20 grams of Indian hemp.
Di prosecutor, Peter Ekuri, tell court say di offence break NDLEA law wey dey for Naija constitution.