By : Jolayemi Olajide
Lagos Assembly don gree on the new Lagos State Wealth Fund Bill, 2025 to keep money for future generations.
Di oga kpatakpata of Finance Committee, Hon. Obafemi Saheed, dey ground for di house of assembly read di report to the House after di bill pass second reading.
From dere, senior man Speaker, Mudashiru Obasa con konfam dis ogbonge bill wey go make Lagos rich, say na only people wey get sense and heavy experience go manage dis wealth fund.
As the elders dey talk, “tree wey strong today, na because dem look am well when e dey small,” so like dis di lagos state House of assembly don secure di state future with dis ogbonge bill.